Entertainment

BBNaija 2020: Prince and Kiddwaya has been evicted

BBNaija 2020: Prince and Kiddwaya has been evicted

 

Prince and Kiddwaya na di latest housemate to leave di Big Brother Naija reality television show.

Out of di four housemates wey bin dey up for possible eviction dis week na two of dem get di lowest votes from di fans

Dem be di 12th and 13th housemate to chop eviction afta Lilo, Ka3na, Eric, Tochi, Kaisha, Praise, Wathoni, Tolanibaj, Bighto and Lucy.

 

Also Erica wey bin be one of di twenty housemate wey start di TV show also don leave afta her disqualification on 6 September, 2020

 

 

Afta im eviction, Prince tell Ebuka say im eviction no come as surprise to am as im bin feel say dis go be e final week for di house.

For Kiddwaya, im say “to win di 85 million Naira no ever bin be e goal” before e enter di house.

Im plan na to “hit di gym to dey mentally fit first as im no wan rush into anytin.”

Related Articles

Back to top button
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com