News

Covid-19 Nigeria update: President Buhari, Osinbajo take Oxford-AstraZeneca vaccine for live TV

Covid-19 Nigeria update: President Buhari, Osinbajo take Oxford-AstraZeneca vaccine for live TV

Buhari and Osibanjo take Covid-19 vaccine

Nigeria president, Muhammadu Buhari don take im own jab of di Covid-19 vaccine.

Vice President of di kontri, Yemi Osibanjo also follow take di AstraZeneca vacine for live television on Saturday, 6 March.

Afta e receive di vaccine, President Buhari tok say as e don receive e first jab of di vaccine, e “wish to recommend am to all eligible Nigerians to do di same so dat we fit dey protected from di virus”.

Di Oga of Nigeria Primary Health Care Development Agency (NPHCDA), Dr Faisal Shuaib dey hope say di President vaccination go ginger pipo to also get vaccinated against Covid-19.

“We dey hope say when Nigerians see leaders see oga president and di vice president take di vaccine, e go give dem confidence say di vaccine dey safe,” Dr Shuaib bin tok when dem dey launch di vaccination programme for Abuja on Friday.

According to Dr Shuaib, members of President Buhari cabinet go begin take di vaccine on Monday

Dem officially launch di programme on 5 March for frontline health workers for Abuja.

Nigeria E-vaccination programme

Important tins about Nigeria vaccination programme

  • Official programme launch na on 5 March for frontline health workers; di next day di kontri leaders go collect
  • Next na vaccination for state level and state governors go dey encouraged to collect di vaccine live to give residents confidence say e safe. Dis go happun on 12 March
  • States wey never meet di requirements, like security for dia vaccine cold storage room, no go get any vaccine dose
  • Everybody wey wan collect di vaccine must fill form. Dis go determine di wia and when di injection go take place.
Africa vaccination map

Related Articles

Back to top button
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
× How can I help you?