News

President Muhammadu Buhari don call for di end of estimated billing of electricity consumers

Nigeria President Muhammadu Buhari don call for di end of estimated billing of electricity consumers across di kontri.

 

Di president for statement ontop twitter also direct di nationwide mass metering for pipo across di nation.

President Buhari also approve one-year waiver of Import Levy ontop electricity meters, so dat Nigerians wey no get meters go fit get supply as early as possible at cost wey make sense.

According to di president, di Federal Government dey work to ensure say DisCos dey committed to increase di number of hours of electricity supply per day, and quality of service. Buhari add say mass metering program dey go on for di kontri.

Di statement from Buhari dey come as di National Electricity regulatory Commission, (NERC) also deny tori of increase in electricity tariff.

 

 

Related Articles

Back to top button
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
× How can I help you?